Hot Post

5/recent/ticker-posts

"Twitter Get Spiritual Problem?" - Super Eagles Star Delete Vawulence App

By Olamide Oyetunji - Before Before Super Eagles player Peter Osaze Odemwingie don shake table for popular social media app wey vawulence dey fly.

Osaze Odemwingie wey sabi play 7 and 11 the time wey he dey totori African defenders in the colours of Naija talk say Twitter get spiritual problem since Baba Olowo Elon Musk take over.

The Edo guy wey win Premier League sabi Player of the Month three times when he dey ball for West Brom yarn for the app that the vawulence headquarter get some unfamiliar spirit before he come finally deactivate his official account @OdemwingieP.

"24/11 my last day on this platform. Maybe one video maybe not. I see the spirit since ⁦Elon Musk⁩ takeover and the fruit is more than obvious. I don’t say to anyone who calls himself/herself Christian to do the same but for me personally it,s «Нет, уж лучше вы к нам."

Post a Comment

0 Comments