Header Ads Widget

Update:    Happy New Year!   List of 12 Teams for Morocco 2024 Women's AFCON     Football and Other Sports: Live BLOG   Nigeria Football and Other Sports: Live BLOG 2024 AFCON Opening Game: Ivory Coast vs Guinea-Bissau, 13th January 2024 20:00WAT.      • Welcome to Nigeria Football and Others Media (Nigfooty Sports), the Home of Global Sport.     ☎️ To contact us, call, +2349074986288 - Nigeria Football and Others Media

Enugu Rangers Fall Kano Pillars Hand

For the only NPFL match wey shele for the weekend because of States FA cup matches wey dey take place for every corner for Naija and Come lead to the fact wey be say Rangers get jara matches wey dem never play because of Caf Competitions.

Enugu Rangers wellu come Sai Masu Gida for Nnamdi Azikwe stadium as dem dey try put the beating wey dem chop for Zesco United hand last weekend wey make their Coachi Chukwuma Agbo yarn say dem never chop for many days say dem eat only Banana.
The home team come out with swagger as the Kano Pillars Mai-Guard use garagara fall Ifeanyi George inside the box 18 for first minute before Chibuzor Madu convert the penarity to give the Flying Antelopes lead but it no take time as another Madu waka come when Chiamaka Madu doubles the lead for the champions in 6th minutes.

The drama no finish for Enugu as Rangers brand new tear rubber player Ifeanyi George add salt to soup for last minute for first half. Kano pillars come end the first half with hope as Adamu Mohammed gets one for them before Ref blow whistle. Enugu Rangers come lock defence for second half to finish the game jeje with 3-1 victory and the win make them get 16points for bombom of the table as Kano pillars still siddon for 12th position with 24points.

Photo Credit : npfl.ng

Post a Comment

0 Comments