Header Ads Widget

Update:    Happy New Year!   List of 12 Teams for Morocco 2024 Women's AFCON     Football and Other Sports: Live BLOG   Nigeria Football and Other Sports: Live BLOG 2024 AFCON Opening Game: Ivory Coast vs Guinea-Bissau, 13th January 2024 20:00WAT.      • Welcome to Nigeria Football and Others Media (Nigfooty Sports), the Home of Global Sport.     ☎️ To contact us, call, +2349074986288 - Nigeria Football and Others Media

We Must Drink Garri Withu NPFL Cup-Mfon Udoh

Enyimba Senior man Mfon Udoh don come out to assure fans and bad belle people wey dey write hin team off say dem dey ready to win Naija league this season.

The Captain wey be the record goalscorer for Naija league yarn say dem no dey Naija league to make up numbers base on wetin happen last season wey dem finish for 10position.
"Impossible is nothing. Everything is very possible. My aspiration and that of my teammates is to help the team reclaim the league title and win the Federation Cup.
"We are not under pressure, but there is a deep desire and hunger in the team for trophies, which is what we (Enyimba) are known for. It is our reputation and everyone knows us for winning laurels. We will try to replicate that this season,"He tell npfl.ng.

He come sama calabar people plenty gbosa for their Afang Soup and their plenty support upon say dem come out to watch dem even as Enyimba still dey renovate dem stadium.
"Calabar fans are fantastic. I commend them for always coming out to cheer us and enjoy the game. Most of them are surprised on the quality of play and organisation of the league. The support has been massive and we are highly motivated,"he talk.
The Coachi Lala wey be Gbenga Ogunbote come add jara on top say Calabar people dey wonderful
"Calabar fans love good football. Their show of love, passion and commitment is amazing. I am not surprised at what we are getting here, but we have to do a lot of work to make them happy always,"Ogunbote yarn npfl.ng.
Na Mfon Udoh score two goals wey help Enyimba win Nasarawa United 2-1 on Sunday.
Enyimba dey numba four position but dem dey go Maiduguri to face El Kanemi this weekend.

Photo Credit : npfl.ng

Post a Comment

0 Comments