Header Ads Widget

Update:    Happy New Year!   List of 12 Teams for Morocco 2024 Women's AFCON     Football and Other Sports: Live BLOG   Nigeria Football and Other Sports: Live BLOG 2024 AFCON Opening Game: Ivory Coast vs Guinea-Bissau, 13th January 2024 20:00WAT.      • Welcome to Nigeria Football and Others Media (Nigfooty Sports), the Home of Global Sport.     ☎️ To contact us, call, +2349074986288 - Nigeria Football and Others Media

Make NTA Kuku Return Us Back to 1941

No be shere shere when we watch Naija versus Cotonou for Nigeria Television Authority because of say normal Supersport no fit show am based on contract gbege wey dem get with Confederation of African Football wey we sabi as CAF.

Apart from the picture quality wey resemble the time wey Baba Awo(Obafemi Awolowo) and Late Pa Nnamdi Azikiwe dey fight our Kolonear masters for Independence with balubalu transmission wey be ogbonge wey oyinbo people dey call HD- High Definition.
he largest television network in the Africa collect right to broadcast Nigeria Professional Football League from the League Management Company but dem fumble big time as they go show the first 20 minutes of EL Kanemi vs Kano Pillars and from there run join PDP or APC political campaign without prior abi proper notice.
Na only for NTA Alex Iwobi still dey play for Arsenal, na only for NTA John Obi Mikel still dey play for Super Eagles, na only for NTA Olaoluwa Aina dey play for Torino from Chelsea onloan, na only for NTA Super Eagles beat Nigeria 2-1 and na only for NTA dem dey give commentary like say dem shayo before a serious international match.

You wan talk about the studio setup nii abi na the old civil servants wey no gree make the young and upcoming presenters grow abi na the blur visual quality wey go make Tammy Abraham reject playing for Nigeria one million times.
Make MTN go, pursue DSTV, we no want GOTV, make Startimes carry their wahala dey go but common Nigeria versus Benin Republic inside our own Uyo, Naija television stations no fit broadcast am for the world.

"Just been informed that CAF got in touch with NTA to broadcast the game but the management turned down the request because the time was too short.

However, the powers that be in Abuja residing in that solid rock gave counter instructions to NTA to go and cover the game. Realizing that it was impossible to move men and equipment to Uyo from Abuja, the NTA management decided to have their Port Harcourt station cover the game. When they got to the stadium with less than an hour to kick off, they couldn’t mount their cameras properly because fans had taken over all available space and they had to make do with whatever space they could find.

Hopefully, the guys will mount their cameras properly at half time for better coverage of the game." --GODWIN Enakhena

By Olamide Oyetunji

Post a Comment

0 Comments