Hot Post

5/recent/ticker-posts

Super Falcons Hard Way; Na Thomas Dennerby Sure Way

Super Falcons yet again don escape danger just like from the beginning.

Thomas Dennerby team get something wey dey terrible, something wey dey disturbing,something wey dey strong,something wey dey stressful, something wey dey emotional, something wey dey narrow.
Dem give the Swedish man job to come do wetin our own ibile Coaches no dey do with hope that the man no go Lars Lagerback us.

Dennerby give us first heart attack as Banyana Banyana put one for our net for AWCON opening match for Ghana.

He add red oil for inside salt when we suffer to comot Cameroon for Semi-final with put am for ground and play am inside net.

We enter labour room to born another AWCON title as Banyana Banyana resemble Brazil for Final.

God dey wonderful for WAFU CUP group stage but we carry penarity take marry Mali for Semi-Final,before Uchenna Kanu do like Abija to take equalize as we PK padlock their mouth for Abidjan for Final.

 
We enter World Cup wey be the koko but we no sabi our way against Norway before we manage gather liver to beat Korea Republic but we die there for last Group until VAR blow us French-kiss.

Now after we do calculation,permutation with fasting and prayer, we dey play Germo for round of 16 and that one na another hard one but hopefully,Mr Thomas go clear all the doubts.

By Olamide Oyetunji

Post a Comment

0 Comments