Hot Post

5/recent/ticker-posts

Exclusive : Kano Pillars Don Sack Coach Kadiri Ikhana

The latest news wey dey come out hot like tea na the decision of Kano pillars management to sack popular Coach Kadiri Ikhana.

The decision come after the team chop cane for Enugu when dem lose 3-1 to Enugu Rangers wey dey bottom of the table. Kano Pillars no dey perform well recently as the 1-0 home lost few weeks ago still dey our memory and after the first stanza of the league don finish.
Sai Masu Gida dey for 12th position with 24points and as it stand, dem no dey fight for league title and dem no fit beat chest for Continental ticket.

Photo Credit : Goal.com Nigeria

Post a Comment

0 Comments