Header Ads Widget

Update:    Happy New Year!   List of 12 Teams for Morocco 2024 Women's AFCON     Football and Other Sports: Live BLOG   Nigeria Football and Other Sports: Live BLOG 2024 AFCON Opening Game: Ivory Coast vs Guinea-Bissau, 13th January 2024 20:00WAT.      • Welcome to Nigeria Football and Others Media (Nigfooty Sports), the Home of Global Sport.     ☎️ To contact us, call, +2349074986288 - Nigeria Football and Others Media

MFM no fire,Pillars Strong like Olumo Rock,El-Kanemi don catch Plateau

We go dey serve you felifeli as it dey hot on NPFL Matchday Eleven today. Wikki tourist no fit stop the rivers from flowing as dem draw for bauchi,Elephant no fit March Shooting Stars eventhough one sooting player collect red card.

Remo stars demo but Kano Pillars through Rabiu Ali show say dem strong like olumo rock while plateau united drop more points as dem play kondo Kondo with Lobi stars but Daniel Etor score the only goal that help Rangers beat ABS. Martins Ursule score for injury time to help Katsina fire MFM 2-1 as Samuel Mathias round up scoring for El-Kanemi warriors wey shine pass sun for Maiduguri as Abia Warriors silent tornadoes with 1kondo.


Gombe show FC Ifeanyi Ubah 2gobe while the last match wey go shele on Thursday na between Nasarawa and Akwa United.

Full Results
Wikki 0-0 Rivers
Rangers 1-0 ABS
Katsina 2-1 MFM
Remo 1-1 Pillars
Enyimba 0-0 3SC
Plateau 0-0 Lobi
Gombe 2-0 FCIU
Abia Warriors 1-0 Tornadoes
El-Kanemi 3-1 Sunshine

Plateau united still dey first position on goal difference above El-Kanemi on 21points, Kano pillars don enter don enter number 8 while Rangers don enter number 13. Ifeanyi Ubah, Shooting and Remo stars dey shine for Relegation planet.

Post a Comment

0 Comments