Hot Post

5/recent/ticker-posts

To Play Ball Dey Hungry Me-Waheed

Belle dey sweet MFM player Adebayo Waheed wey be say him dey play hin first season for Naija professional league.
The smallie striker pake hin first league goal when Kano Phillars collect one robo last sunday after he replace Adegboyega Adekunle for 60minute before he come fly like labalaba nod ball for inside net.
He come further thank him coachi lala,him teammate dem backroom staff for the opportunity even though him age na 18.

"I want to thank God for giving me this opportunity and secondly I want to thank the coaches and my teammates for giving me the opportunity to be in the team and to play for the team.

"I'm so excited to score the goal, I want to do more and I promise I will do my best for the team and help the team meet its target for the season as I continue to better my football career,he tell hin club website mountaintopfc.com
The Anointing and fire from Baba Olukoya don helep the club siddon for second position as dem prepare to meet Sunshine for Akure on Sunday.

Photo Credit : @LMCNPFL

Post a Comment

0 Comments