Header Ads Widget

Update:    Happy New Year!   List of 12 Teams for Morocco 2024 Women's AFCON     Football and Other Sports: Live BLOG   Nigeria Football and Other Sports: Live BLOG 2024 AFCON Opening Game: Ivory Coast vs Guinea-Bissau, 13th January 2024 20:00WAT.      • Welcome to Nigeria Football and Others Media (Nigfooty Sports), the Home of Global Sport.     ☎️ To contact us, call, +2349074986288 - Nigeria Football and Others Media

Rangers try but dem no reach as Olatunbosun Sikiru and Stephen Odey power MFM to Victory

Sweet football dey on display as MFM welcome Enugu Rangers to Agege for the first Friday Night match of the Season as Rangers collect 2-1 by fire.

The home team dey enjoy wetin resemble their brilliant start last season as dem dey continental position on the league table unlike Rangers wey dey danger position.

The match start with gragra as both team dey show swagger, ginger and agbakara in the early minutes but the first chance pay MFM spiritual visit for third minute as Adegboyega controls with hin chest,run past his marker and balloon the ball as Enugu Rangers come wake up when Obinna Nwobodo do rondo for midfield to pass the ball to Bobby clement wey dem block hin shot for 10th minutes.
Rangers continue to dey press when Nwobodo use him leg slice shot to crowd after Aguda don do the hardwork for 14th minute but everything come dey jampark until 23minute wey Olatunbosun fear madu shoot wide after odey don finish work for him but Olatunbosun no gree as he suffer Akor wey be goalie for Rangers on 27th minutes.
Door finally open for MFM as Olatunbosun strike the ball like thunder into the net after Odey don flick the ball for am on 33rd minute as Rangers try to arrange their play when Udeagha kill bird with 5minutes remaining for first half.


Camara dey do oversabi for Camera but Olatunbosun shoot wide on 50minute as things dey bumper to bumper for 10minutes more before Stephen Odey reset the factory setting for Rangers defence with the second goal for MFM.
Rangers try to reduce the price of garri when Etor see him shot hit MFM goalkeeper Folarin palm and come nak crossbar.

Rangers later press the correct button for 81minutes when Bobby Clement score confirm goal to reduce the scoreline but MFM hold body for victory. MFM don jump enter second position while Rangers remain for 16 position.

Post a Comment

0 Comments