
MFM dey enjoy their go start to the league as dem don gather 13points and dem dey 4th position for table unlike Rangers wey get 9points for 16th position.
Rangers international wey don dey busy with Caf champions league for two weeks beat Lobi 2-1 through Bobby Clement goal for last minutes on Wednesday.
Stephen Odey na MFM fire power and Rangers go need plenty water to quench that burning fire from Olukoya boys.
The match go shele for Agege stadium for 7pm naija time and the match last season end with 1-1 ogbono draw.
Photo Credit : MFM FC
0 Comments