Header Ads Widget

Update:    Happy New Year!   List of 12 Teams for Morocco 2024 Women's AFCON     Football and Other Sports: Live BLOG   Nigeria Football and Other Sports: Live BLOG 2024 AFCON Opening Game: Ivory Coast vs Guinea-Bissau, 13th January 2024 20:00WAT.      • Welcome to Nigeria Football and Others Media (Nigfooty Sports), the Home of Global Sport.     ☎️ To contact us, call, +2349074986288 - Nigeria Football and Others Media

Fire Burn Sun,Ifeanyi Ubah floor Rangers for NPFL week 6

Mountain of Fire Ministry wey people sabi as MFM continue to dey burn teams allover the NPFL as dem waka go Akure with Anointing and Fire as they win 1-0 away.

Prince Aggreh score penarity for Ifeanyi Ubah to beat Rangers 1-0 for Nnewi as Adamu Mohammed score for injury time to help Kano Pillars manage win ABS for Kano.
Katsina no allow Tornado happen for Niger as Solomon Kwambe score a kale wey Naija people sabi as Penalrity to help Lobi wicked Wikki for Markudi.
Gombe collect 1-0 for Abia Warriors,Nasarawa united no fit break plateau united back as dem play kondo,Akwa manage 1-0 victory on top Remo head while sooting star make River United suffer 2-1 for Ibadan to end their gragra unbeaten run.
Plateau united dey enjoy for top as MFM dey flow with anointing for second, ABS,Enyimba,Abia and Lobi get 10points.
Nasarawa,Rangers,Remo,Niger Tornadoes,Akwa and Sun dey shine for bottom with 6points.

Post a Comment

0 Comments