Header Ads Widget

Update:    Happy New Year!   List of 12 Teams for Morocco 2024 Women's AFCON     Football and Other Sports: Live BLOG   Nigeria Football and Other Sports: Live BLOG 2024 AFCON Opening Game: Ivory Coast vs Guinea-Bissau, 13th January 2024 20:00WAT.      • Welcome to Nigeria Football and Others Media (Nigfooty Sports), the Home of Global Sport.     ☎️ To contact us, call, +2349074986288 - Nigeria Football and Others Media

Pidgin Friday : Administrators Wahala Na Ant for Sports Beans for we countiri

As 2016 dey waka dey vamus small small with gengen to,Pipo wey suppose dey enginear the growth of our sports but na dem dey destroy am.
Moni no dey but na dem dey fly upandan like winchy winchy,dem no get money for athletes but dem dey charter flight,dem dey collect salary.
All dem sabi na big Vocabularies like Spended.
Our Olympics athletes dey do gbanbi allah fine bara to travel to Rio and all the agbaya no get shame as if dem no get children for house.
For football team,Na to blame the innocent Coach and Team Captain for going to United State of Nigeria.
Na true say una go gain many things especially for money matter,na reason wey una dey wear big cloth with large and deep konga pocket.
Una dey find am easy to owe players money but una forget say even Ashawo will charge money before service and una wey be dem Customer must comply.
Watch am,ur belle dey grow big and begin dey give you health concerns and you dey wonder why ?
You no fit plant Spaghetti and harvest Onions.As you dey consume wetin no belong to you na hin you dey poison yourself slowly.
Change before before 2017

Post a Comment

0 Comments