Hot Post

5/recent/ticker-posts

Pidgin Friday : I No do Interview to yarn about kudi-Mikel John Obi

Chelsea Sabi player and the Skippo lala of Super Eagus of Obodo Naija don finally pour cold water on top of the aproko wey people dey spread around like Iya bisi bedsheets say hin dey make request make dem dey pay dem Match Bonuses and camp Alawi for hard currency which is dollars instead of our own ibile moni wey be Naira and kobo.


According to press release wey dem NFF release yesterday, Papa Ejima himself wey dem dey call Odogwu talk am for oyinbo "I never granted any such interview & the team has not made that kind of demand at any time to the football federation".
Did kind News gud so as make we concentrate on our next gbege wet go shele on Novemba 12 for Uyo as we go wellucome Algeria.

Post a Comment

0 Comments