Hot Post

5/recent/ticker-posts

WrestleMania 39 : Lagos Boy Ready to Beat WWE Brock Lesnar Balablu


Naija boy wey dey represent us for World Wrestling Entertainment Jordan Omoghehin go face the toughest opponent of his career for WrestleMania.

Jordan Omoghehin wey Oyinbo people and WWE WWE Universe dey call him name Omos go enter battle with the "Beast Incarnate" Brock Lesnar for the most ogbonge stage of them all.


After dem don talk-talk for so many weeks for Monday night RAW, Brock Lesnar don use MVP do scapegoat and him don accept to jam Omos.

Omos na Nigerian giant wey dem born for Eko before hin come japa go Obodo Oyinbo but the number three dogoyaro for WWE history dey speak Yoruba fluently.


The 28-year-old Bobo don dey get experience small small and make we no forget say him win WWE RAW tag team title with AJ Styles for WrestleMania 37.

Post a Comment

0 Comments