Hot Post

5/recent/ticker-posts

Portugal Pour Sand Sand For Naija Garri For Beach Soccer World Cup

Nigeria collect ten goals wey no get Abula for their opening match of the FIFA Beach Soccer World Cup wey dey shele for far away Paraguay.

Nigeria Sand Sand beach soccer team wey everybody sabi as Super sand sand Eagles follow omoye waka naked for popular Paraguay market wey dem dey call Mercado Cuatro on Friday as dem chop am for the hand of current European Champions inside Los Pynandi World Cup Stadium wey dey Obodo Luque.
Sand sand Eagles be dey think say dem fit do the unthinkable as this time around, dem no carry all the agbalagbi wey the world sabi based on say dem don old with person like Isiaka Olawale, Ogbonnaya Okemiri and Bartholomew Ibenegbu a.k.a mosquito siddon for house dey do faaji.
The youngest smallie player to ever play FIFA Beach Soccer World Cup Abu Azeez score for end of first quarter to put Naija for front after goalkeeper Dami Paul don shine for 10 minutes to make sure say Portugal no smell the net at all.

Trending: Exclusive: FIFA U-17 World Cup Golden Boy Sani Emmanuel in Serious Predicament

Like person wey wake dead body na hin Portugal take tanda for second quarter as dem rush goals take scatter the dada of Adamu Ejo boys with goals from Nuno Ricardo Santos Belchior, Jordan Santos, Bruno Torres, Rui Coimbra and Léo Martins to separate night comot for day.
The 2015 champions come use the last quarter do jeunjeun training to finish our boys wey prepare for FIFA World Cup on top of horse for Bar beach and Elegushi with another goal from Belchior before Torres score two to complete his hat-trick while another one from Coimbra go make the second best team in Africa shed tears.
Portugal go come crown am as Beach Soccer goalscoring Legend João Victor Saraiva a.k.a Madjer wey don score over 1000 goals for him career go nail Naija coffin with his own for the match to finish 10-1 in favour of Portugal without ororo wey people sabi as Cristiano Ronaldo.

Naija go try to shake body small as dem now get mountain wey pass Kilimanjaro to climb as dem go face current Asia Champions Oman next on Sunday. Oman collect correct beating from World Champions Brazil in the other group D match by 8-2.

By Olamide Oyetunji

Post a Comment

0 Comments