Hot Post

5/recent/ticker-posts

Bukayo Saka - I be Omo Naija

Arsenal smallie Bukayo Saka don drop bombshell say he be confirm Naija, Nigfooty.com dey yarn una the report.

Bukayo wey be obodo oyinbo akata boy but him parent na Nigerians use him mouth talk this thing for one small owambe wey U.K boy Jadon Malik Sancho/EA Sports throw for London.

Popular Arsenal fan, Kelechi wey be proudly Naija use him green and white blood discuss with both Folarin Balogun(another Naija boy) and Bukayo Saka but him major focus na on Bukayo.

Kelechi ask Bukayo if he is British-Nigerian.

"Where are you from? You are British- Nigerian right?” He reply am by saying ” I am a Nigerian"

Bukayo Saka don play for England U-16, U-17, U-18 and U-19 teams from 2017 to 2019.

By Olamide Oyetunji

Post a Comment

0 Comments