Header Ads Widget

Update:    Happy New Year!   List of 12 Teams for Morocco 2024 Women's AFCON     Football and Other Sports: Live BLOG   Nigeria Football and Other Sports: Live BLOG 2024 AFCON Opening Game: Ivory Coast vs Guinea-Bissau, 13th January 2024 20:00WAT.      • Welcome to Nigeria Football and Others Media (Nigfooty Sports), the Home of Global Sport.     ☎️ To contact us, call, +2349074986288 - Nigeria Football and Others Media

Ifeanyi Ubah Share Points with Akwa, NPFL Teams Sabi Home-Work

Ifeanyi Ubah FC on Sunday Night confirm to us as the only away team wey get jojo and nono for NPFL when dem visit Akwa United for Uyo. Pascal Seka shakara the home team with early goal for second minute before Akwa united come say lailai,atall atall na hin bad pass when dem equalize through super-sub Cyril Olisema in the 74th minute as Ifeanyi Ubah manage to lock door eventhough dem play short-one because of late red card.

Sadiq Shuaibu goal ensure say MFM lose narrowly to Gombe and Mfon Udoh bath inside River with Goal Soap,Katsina arrange one kondo for Rangers as Plateau take ABS measure 4 by 1.

Abia Warriors put three balls inside the basket pillars will carry enter Kano as Ojo Olorunleke penalty save no stop Tornado from shining as Victor Mbaoma score the winning penarity for 77th minutes to help Remo wicked Wikki for Sagamu.

Thomas Zenke sink 3sc with 84th minute goal just like Samuel Mathias do am for same time to give El-kanemi win over Lobi.

Matchday 15 Results
Katsina 1-0 Rangers
Remo 2-1 Wikki
Enyimba 1-0 Rivers
Plateau 4-1 ABS
Gombe 1-0 MFM FC
Abia Warriors 3-0 Pillars
Nasarawa 1-0 3SC
Tornadoes 2-1 Sunshine
El-Kanemi 1-0 Lobi
Plateau don return to top as MFM and El-Kanemi dey assist dem while Rangers dey top from bakassi of the table,Remo dey breath for number 16 as Ifeanyi Ubah and Shooting stars dey do bumper to bumper for 14 and 15 but Sun dey shine inside River for danger zone.

Photo Credit : npfl.ng

Post a Comment

0 Comments