Hot Post

5/recent/ticker-posts

Tornado happen for Sagamu,Abia Warriors Allow Sun to Shine as Plateau still be Fada

Na midweek match day happen yajo yajo for Wednesday and Thursday as NPFL nak week seven this week.

Na six matches we enjoy base on say Wikki,Rivers United,Ifeanyi Ubah and Rangers international go abandon Eba,Akpu,Afang soup and tuwo to take totori some intercontinental matches wey Caf don serve dem for this weekend.
Remo continue to disappoint as dem no fit withstand Tornado wey happen for Sagamu as dem lose one kondo.
Enyimba give 1okpa to Akwa United for calabar,plateau united as ABS use one penalrity comot fire for MFM body.
Sun manage shine for Abia as dem play 1-1 Ogbono,Plateau win war of El kanemi with 2-0.

Gombe do Nasarawa gobe with 1-0.
Plateau United still dey top with 17points,MFM,ABS and Enyimba get 13points,Remo,Nasarawa,Rangers and Akwa get 6points for bombom of the table.
Lobi,Kano phillas,Rivers,Katsina,Ifeanyi Ubah,Sooting,wikki and Rangers never play their week 7 matches as dem don postpone dem.

Post a Comment

0 Comments