Update: :     FIFA World Cup Qatar 2022     Football and Other Sports: Live BLOG   Nigeria Football and Other Sports: Live BLOG  Qatar 2022 FIFA World Cup Opening Game: Qatar vs Ecuador, Sunday 20th Nov. @ 17:00 WAT.      • Welcome to Nigeria Football and Others Media (Nigfooty Sports), the Home of Global Sport.     ☎️ To contact us, call, +2349074986288 - Nigeria Football and Others Media

Plateau chop afang, Nasarawa nasa Abia, Gobe for Gombe,Tornado fire Enyimba

NPFL don enter week eight so as we people hate to pretend to hide their joy on top happiness for everything wey don happen so far.
On Sunday,Lobi stars no shine as dem play zero zero for Markudi with Katsina.
Peoples Elephant no fit withstand Niger Tornado as El-kanemi carry Gobe give Gombe.
Nasarawa nasa Abia Warriors 3-1 for Lafia as Sun no shine for Akure as ABS carry ogbono and Okro wole dem.Akwa united nak Plateau 2 by 1 Akpako for Uyo.

Plateau still dey jolly for top of table as ABS carry second with 14 point,Enyimba get 13point with MFM wey get 1jara match.
Kano Philas solid gidigba for 10 posi as dem get double match for hand.Wikki and Rangers dey participate for continent as dem dey relegation with 2 matches for their pocket.
Matchday 8 Results
Lobi 0-0 Katsina
Tornadoes 1-0 Enyimba
El-Kanemi 3-0 Gombe
Nasarawa 3-1 Abia Warriors
Sunshine 2-2 ABS
Akwa 2-1 Plateau

Post a Comment

0 Comments