Header Ads Widget

Update:    Happy New Year!   List of 12 Teams for Morocco 2024 Women's AFCON     Football and Other Sports: Live BLOG   Nigeria Football and Other Sports: Live BLOG 2024 AFCON Opening Game: Ivory Coast vs Guinea-Bissau, 13th January 2024 20:00WAT.      • Welcome to Nigeria Football and Others Media (Nigfooty Sports), the Home of Global Sport.     ☎️ To contact us, call, +2349074986288 - Nigeria Football and Others Media

Enyimba Call Police But Dem No Win Case, EL-Kanemi Reduce the Height of Plateau

NPFL don reach Matchday 10 with no time as everything just dey change like Naija economy day by day.
On Friday, MFM fire Rangers 2-1 for Lagos and Stephen Odey no go ever stop to dey score like rain.
Na Ojodi for Sooting stars as dem draw 1-1 with Remo Stars on Saturday wey come mean say,Fatai no pass Fatai while two goals by Alhassan ensure say Akwa united popo Abia warriors for Uyo.
Other eight matches happen for Sunday Evening when Enyimba call police for Lobi in Markudi but dem lose case by 2-1,El-Kanemi warriors capitalize on their away win for Umuahia last week by giving Nasarawa blue and black with 2-0 victory for Maiduguri.
ABS,Kano Pillars,Niger Tornadoes, FC Ifeanyi Ubah and Sunshine stars shine with 1-0 photocopies at home.

Matchday 10 Results
ABS 1-0 Wikki
Pillars 1-0 Katsina
Lobi 2-1 Enyimba
FCIU 1-0 Plateau
Tornadoes 1-0 Gombe
El-Kanemi 2-0 Nasarawa
Sunshine 1-0 Rivers
MFM 2-1 Rangers
3SC 1-1 Remo Stars
Akwa Utd 3-1 Abia Warriors

Plateau United still dey top upon say dem lose for Nnewi,El-Kanemi and ABS don climb ontop MFM wey hold 4th position with Anointing, Enyimba dey number 6 with 14points as Sun dey shine from number 11.
Meanwhile,Wikki,Rangers,Sooting Stars and Remo Stars dey do Relegation community meeting for bombom of the table.

Post a Comment

0 Comments