Hot Post

5/recent/ticker-posts

Tornado Sekem Rangers,Mfon Udoh Born Goals

Rangers international continue to disappoint the people of Enugu after dem allow Tornado to happen on Sunday.
Chidiebere Ajoku draw like okra to cancel Godwin Aguda Ogbono to further make Flying Antelopes turn Snail for league table,Lobi Stars no gree Rivers united flow as dem play tondo tondo for portal,Pillars from Kano no fit hold fire wey comot for mountain from inside Lagos,Wikki too Wicked for Ifeanyi Ubah as Remo Remind EL Kanemi the National Anthem twice for Sagamu.
Gombe give two gobe to Sunshine Stars while Plateau United take narrow cane flog Warriors from Abia and na sweet tin Mfon Udoh do for the People's Elephants as his two goals give dem slim victory against Nasarawa.

Results
ABS 2-0 3SC
Rivers Utd 0-0 Lobi
Wikki 3-1 FC Ifeanyiubah
Rangers 1-1 Tornadoes
Remo Stars 2-0 El-Kanemi
Enyimba 2-1 Nasarawa
Plateau Utd 2-1 Abia Warriors
Gombe Utd 2-0 Sunshine
MFM 1-0 Pillars
Katsina Utd 1-1 Akwa Utd
Plateaus still dey enjoy first posi as MFM use Anointing enter second place to lap Enyimba and ABS for 10points,Kano Pillars hold 11posi but dem tie turban with Rangers,Remo,EL Kanemi and Sunshine with 6points,Nasarawa and Niger Tornadoes chop 5tuwo as Ifeanyi Ubah and Shooting Stars do Paul and Peter with 4Points alone.

Post a Comment

0 Comments