Rangers players still dey celebrate Christmas and New year as Fortune Omoniwari goal for ten minute no fit prevent defeat for the League Champions.
Emeka Isaac's deflected effort level ground for visitors for first half.Na Godwin Zaki score penarity for 72 minute, after Chibuzor Madu don play Basket ball for inside hin box 18.
Na only Ibrahim Mustapha waka come for Enyimba to beat Sunshine for Calabar,Guy Kuemian and Emeka Ogbugh sabi where net dey for Rivers to flow pass El kanemi Warriors.

Katsina halla Gombe united 2-1 as Rain no gree fall between Wikki and Nasarawa United.
Sikiru Olatunbosun, Stephen Odey and Adegboyega Adekunle make sure say Niger Tornadoes collect three Agbalumo for Lagos as Remo Stars no shine as dem collect welcome to NPFL gift from Plateau United in Sagamu.
No Bill for Lobi Stars as dem allow Afolabi Waheed and Sunday Faleye serve dem plates of Amala and Ewedu for Ibadan with Shooting Stars but the game wey get controversy na between Kano Pillars and Ifeanyi Ubah even though say Kano Pillars dey lead by 1kondo before dem stop am.
Photo Credit : LMCNPFL
0 Comments