Header Ads Widget

Update:    Happy New Year!   List of 12 Teams for Morocco 2024 Women's AFCON     Football and Other Sports: Live BLOG   Nigeria Football and Other Sports: Live BLOG 2024 AFCON Opening Game: Ivory Coast vs Guinea-Bissau, 13th January 2024 20:00WAT.      • Welcome to Nigeria Football and Others Media (Nigfooty Sports), the Home of Global Sport.     ☎️ To contact us, call, +2349074986288 - Nigeria Football and Others Media

Ifeanyi Ubah Quench MFM withu Petiro, Shooting Stars Collect Late Kondo, Jos Cold for Enyimba Inside Naija League

The new made in 9ja footuball season continue for across the countiri dis middle week.
Ifeanyi Ubah FC do launching of their Ochara Stadium as dem take vex of  wetin shele between dem and Kano Pillars during weekend take enter fire people with wetin i go call Ifourti Oloyi.

Yaya kone, King Osanga, Jimoh Oni put the Nnewi team for Con3-0 before Ifeanyi Onuigbo put jara on top for second half.
Solomon Kwambe make sure say Lobi Stars wise pass Kano Pillars as Sunday Oluwadare make Sun Shine for Akure over Shooting.

Elsha Golbe, Kabiru Umar and Sand Sand Eagles Playa Emeka Umeh no allow Enyimba use Mosquito 'Ikechukwu Ibenegbu' take suck any point comot for jos as Plateau United don win their second match of the season just as Abia Warriors wey beat Katsina United withu two bulala.
Nasoso 1-1 Ogbono draw soup dey reign for some games like ABS and Niger Tornadoes,Nasarawa and Rangers just as Akwa join hand in united chop Okro with Rivers for Uyo.

Gombe united and El Kanemi Warriors wear 2-1 uniform over Remo Stars and Wikki Tourists.
Plateau United dey siddon like king on top league table withu six points as Abia dey carry second,Remo star dey behave like JJC for bottom withu no point while Rangers register 1points to stay for 16posi.

Post a Comment

0 Comments